LESSON TEACHER!😂🤣
Una doh o!
How
de oraizon?! I salute e!
I
remember back in the days, wah been ask Soba my former roommate, why she nor
reason this Nnamdi as dem go Uni together, he sabi book but to get job hard am
nor be small!
I
say Aftohroh, he nor too fine! So nothing like say another woman wan snatch am
comot! *Abi na?!*
Soba
say Mba, Nnamdi family too get spiritual problem! Say she nor wan enter
covenant with poverty! I say i hear o!
Small
time Nnamdi sef go pack small children put for the front yard of their house,
begin teach them English and Mathematics.
E nor too teh wey he see job for one nice
secondary school.
Na
from there he tell us how the principal go dey wink am eye, to come help her
comot wetin nor wan loss for her west, inside her office! *side-eyes*
E
say one nice young female teacher, wey begin dey like him one time, Na so
princi-winchy sack the lady comot!
He
say one day wey she wan kiss am by force, na so he push her comot with reflex,
wey her wig go one side, her hand dislocate!
Na
the same reflex he kukuma use and collect sack letter!
Na Mass he from come one day, inside public
bus, wey one man ask him if he fit do home teacher, he say no problem!
The
man carry him the next day go the office of the Pikin manager.
Nnamdi say the salary wey dem offer him na
weekly o. And the money even pass how much he ever earn combine since he begin
hustle!
Na
so Nnamdi resume o, choi! He say if we see as house fine eeh, just one small
pikin get two nanny and two hefty body guards.
He
say everything dey go well as the pikin sef sabi book. E say he begin wonder
why the parents nor want make she go school outside the house!
He
say na front he dey face with the job, he say no picture dey for the walls and
he never see the parents of the boy/girl. *clearsthroat*
Na
so the first week go,he collect better money. He go charter better okrika
shirts and trawziz!
Hin
shoe wey don see life too become history.
*Praize
master Jeezeehz!*
He
buy me borleh and fish wey carry shoulder pad! *choi! Aclear the crime scene!
No single evidence remain..Aftoroh fishhead and fishbone nor dey kukuma regrow
if person plant am! *pops gum! *
The Joose wey he buy for Soba, na me drink am! As the Assistant Middle woman and Taataa wah be! I still dey grow abeg!
The
pikin say e don hear!
Nnamdi
say e nor know as the Mathematics just enter him body and he sef come forget to
press bell and remind the Nanny.
He
say na as he go ease himself for toilet, come back, na so wonder start!
He
say suddenly, the Pikin begin look floor like say na another thing dey there!
He
say from that one, he/she/them begin use hand rub Nnamdi shoe. Then he/she/them
go sidon for chair and begin whisper something wey e nor hear well!
He
say he call her name and she shout for am say no be her name be that!
She
say her name na one long English name!
Nnamdi say he confuse and him brain nor quick pick make he press bell to call Nanny!
He
say na so the Pikin carry pencil begin write for her cloth and he don begin
fear as she sidon again, call the Nanny by her name say 'Silly Beatrice, where
are my pearls!'
He
say as the Nanny hear her name for high tempo, she rush enter the parlor, she
wan run back in fear!
I don dey confuse!
Nnamdi
still nor understand wetin dey happen! He say for him eye, na so Nanny carry
intercom call the two hefty men and her second wey be Nurse!
They
rush enter, say make Nnamdi pack him books, come dey go house!
He
say na so the pikin rush him, jump for him back, hold hand for him neck begin
talk like evil spirit!.
Nnamdi nor remember Jesus o!
Na him Mama he begin shout! He say he never see small
pikin that age, wey get the strength of 1thousand men!
I
say when Jesus face Legion, you think say na by muscle?!
He
say as the hefty men dey try pull the pikin comot, na im he hear dem they tell
the Nurse to move closer!
Nurse position with needle but she nor too near
the girl!
Na as the two men manage comot her from Nnamdi
back, they hold her for floor, wey Nurse gently give 'him/her/them' injection!
Una
see those ones wey dey form pronoun, na because dey never sabi say na Legion
dey use dem play kite!
Nnamdi
say he pick race, forget shoe! But as nobody go open gate for am without
permission, he say na inside the Sekuriti room he hide, begin peep from the
window!
He
say him Nokia phone ring, na the Manager call him to ask if he still wan
continue the job after the unfortunate incidence?!
Nnamdi say, he tell her he wan go collect treatment for hospital and think the matter!
Nna
ehn, i look Nnamdi, thank God for him life!
I
say so na that oyinbo sickness wey the person go get like different different
people wey dey follow share one body, na im he go jam unprepared?! *Chineke! *
I
say he lucky say the pikin nor get any Agboro personality wey dey break bottle!
He
say the one wey jump for him neck nko? I say that one na Frustrated Housewife
Personality!
He
say the one wey dey call her Nurse like maid nko? I say that one na Toxic Madam
Personality!
He say the one wey dey use hand rub him shoe
nko? I say that one na Aboki Personality, he wan hep you clean the shoe! Entrepreneurial ability!
He
say the one wey wan beat the two bouncers nko? I say that one na Samson
Personality, the Bouncers resemble Lion and Bear for her eye!
I
say so you nor even try wait small and see if the one wey go carry money dash
you go comot? That one for be Bizabiza Personality!
He use bad eye look me!
I
say nor be your fault! Na me wey sidon dey hep you rub Aboniki and tie bandage
for neck!
He say he wee never return to the place again!
I say you nor go
collect money for today wey you go? He say he nor think say dem go pay am o!
Nna
ehn, that week Friday dem pay am o! plus
money for Hospital treatment and unfortunate incidence money join!
Na 50naira wah use buy Abonik,i this yeye boy
come return gimme! He nor even add bandage or workmanship money! *Hian*
Mental health no be myth o!
Comments
Post a Comment