SUGAR BABY IN THE MUD!
Una kpoi kpoi kpoi e!
Hmm...
For the compound wey face our yard!
One innocent looking, female corper dey live with one of her female friends!
Small time, one married young man begin find her come. He nor too teh wey he buy her car!
Everything dey go well, until one day wah dey waka pass! *sideeyes*
No be say I waka pass like that, like that...I don already pass, so I come re-waka again.
As I sight the man inside him car ontop phone, when he dey vibrate like vulcanizer engine!
He begin shout! Make she nor call my number again! If I like, I will not send money or even bother to see my children for another ten years! It's my business not anybody's! He cut phone! Hmmm..
Confuse come catch me, so I begin watch the man with my internal eyes! So this man deliberately abandon wife and shidren, he come port sinceee, and turn himself to Bachelor without divorce! *Na wa!*
Anor even know as emotions just carry me that day, wey I remember some of my schoolmates when we dey Primary 5, wey their Papa abandon, carry another woman children train for expensive private schools!
Na one tiny portion of white beans inside nylon, the three of them go share during breaktime. Sometimes sef, the food go don spoil, but they go still lem like that!
Because of them, I dey corner extra food go schoo to sharel!
As my Mama don suspect say I dey carry food share with person, sometimes she sef go don add extra fish or meat! I go reach school begin confuse if my fish get belle, born pikin for road, inside plastic! *Children sense...God abeg e!*
For our primary school, Person must to Lem well and gather energy to chop cane and cut grass!
Shullincase, the noise makers decide say, heaven nor go rest until they carry all of us enter trouble, for headteacher hand!
Plenty cane wey person just chop for another person offence! E don tey wey injustice don dey this life!
Nna ehn, I just talk one prayer for my mind as I come waka pass the car, go my side say 'God abeg, for the children sake, give this man small sense!!'
Today wah dey follow Aunty Peace wey like problem pass repentance talk for frontyard!
Na so I sight the young corper with her friend, come down from keke napep, wey she carry black scarf cover face enter compound!
God of wonders! Na so I even remember say, I even get customer wah nor see for Church last week, inside that very compound.
Aftoroh, Bible say be thine neighbour's keeper! *clearsthroat!*
Anor gree make Aunty Peace follow me enter, as na everywhere she go, person husband dey miss! Abeg my hand nor dey for problem!
Na for staircase I begin hear the young corper dey cry, her friend tell her make she nor jump downstairs o! *yinmu* this one wey like soft life pass bedbug! Which kain yeye jump! *Akuko!*
Na im I say, young lady, it is not the end of thine road!
(I see Karma wey tie fine wrapper, carry cooler wey dey comot hot hot steam, tanda for roadside dey wave you, with cane wey get 2 heads!-*inside my mind!*)
I say your way still dey very lonnnng o!
(So she sef go live long and marry, and see wetin 'roving eyes' dey do housewife for body!- *inside my mind again!*)
Wetin hapun?! Sugar man give her punching out of nowhere for public...*eye opening things! *Hian!*
Nothing wey no get expiry date for this life
Abeg that 'westbead' wey these girls dey wear upandan, get person wey suppose dey tell them say 'e get where o'!
(I Mean say, e get where the bead battery dey low'!)
As power pass power!
As this young corper bend back for Balcony like this, remain small wah for shout! *wetin be dis!*
Even Babalawo pikin nor get incisions for waist reach like that! *Anor fit close mouth!*
I quick comot my hand, rush go house, wash and detoxify my eyes with the blood of Jesus!
So ontop all the one wey dey round her west, oga still collect him car and launch her with punching as parting gift?! *wonderment!*
Nor vex o! E get wetin I begin wonder, be like some people dey like off light when dey wan first do!
Make God no see them, snap photo as evidence for judgement day ba?!
*see fornicator wey get sense!*
First time wey person eye suppose ON like floodlight! Even if Nepa no show, carry Lantern! To check and balance! As anor understand how Normal man go see this kain thing and not fear to still fornicate!
Na so the corper for our own yard come house one time like that, say her 2months old Bobo get serious Eczema wey resemble Map of Libya from him groin area spread to the tighs!
E nor dey baff?! E nor dey smell?! 2 whole months of fornicating?! Under nor dey scratch you sef?! Na wa o!
She say na inside dark dem dey always do! She say na as she mistakenly drag duvet comot from him body as he dey sleep, she look back see am! Choi, these shidren e!
I say you nor dey see am scratch?!
She say na 'pack' e dey 'pack'..My friend comot dia! that one nor be 'pack'!
Na sense he dey use scratch him blokos!
Go meet Matron do serious test!
Carry your co- fornicator go there too!
E Fit be Blackmarket Gonokoko e go carry!
Some men with boxers wey moskito fear pass flit! *side eyes*
Anyways ! Oga eye clear, he don go back house to him wife!
Pain me say anor sabi the wife, afor tell her make she carry her husband go do serious deliverance, plus imtensive Hospital Tests!
As na only God know the kain entourage wey don build habitat for him terrain spiritually too!
Make she nor go carry wetin nor be her own!
Corper don resume keke napep movement, until her waist go catch another prey! Na hia we dey!
Comments
Post a Comment