THE BROTHER-IN-LAW!😂🤣

 


Una compliments of dey Hicor-normi o!

My customer say she nor dey do anything wey stress her last Christmas season.

I say una nor get visitors? She say na only one Brother-in-law she kukuma get. Her own twin sister dey obodo oyinbo.

She say the thing wey her Brother-in-law (BIL) carry her eye see last year! God forbid bad thing!

I balance say make she knack me tori o...

She say she buy two gigantic okuko, bag of rice and other things say at least, Christmas and new year don settle.

She say she go salon come back, one full, mature, okuko wey get ‘bearbear’ don miss! *Hian! *

 Chineke! Who wan enter balcony for upstair, get confidence and lift a whole okuko!

She say her twins shidren dem go their classmate birthday. She never go carry them come back house sef!

Na who she go come ask?? BIL say na inside room he dey all day! *side-eyes*

She say,  so he nor hear okuko wey dey shout like say person wan thief am?! He say mba!

Issoraite!  Na last minute she go buy frozen turkey to balance the thing!

My Customer cook Jellof rice and turkey, and other small chops wey she order!

She comot go hospital to see her Mother-in-law(MIL) wey dey on admission with Orbii! 

*This her MIL wey threaten her say she nor go see next December after small kworeh! *

Na im dey come back house, the second okuko don enter metaverse!

She nor even see feather talk less of chicken shoe!

 

Na im she say she crase ! Wey she go face her BIL and say if he nor confess, he kukuma know say she be crase! She Say she go call the entire community on top him matter! Kiikiikii...

Nna ehn, nothing happen!

He still deny say e nor see person wey kidnap okuko!

Na boxing day wey person begin bang door at 6am! Na wetin be this?!

 Customer say na police show face with one guy, that one say dem bet and her BIL nor gree pay in full! So he agree installment, as he no get money!

Na so her Brother-in-law go snap okuko pisure to negotiate! Na so he carry the okuko give am as part payment, some days to Christmas!

Ehn ehn so wetin come remain?!

He say BIL still dey owe am, so he wan come carry the second okuko or money balance!

I say wetin your Orbii talk?!

She say her Orbii pay the boy, they comot with police! As he nor dey like make anybody hear their voice for their compound!

Ok na! So where the Second okuko go?! He deny say no be him o!

Anevasi o! Broad daylight korokoro lie lie!

Na for evening wey Landlady call my customer for phone say, thank you for the okuko o, as her BIL don begin take care of him wife, wey be her daughter!

*proposed wife na landlady pikin! *

Landlady say she nor mind if my customer send groundnut oyel wey dem go use fry the okuko join o!

* I don laff throway leg for up! God abeg! *

I say you hope you add half bag of rice join the oyel?!

 My Customer say she nor only go retrieve okuko, she say Landlady sef chop elbow on her way out!

Kiikiikii...! This one off me o!

Comments

Popular posts from this blog

SUGAR BABY IN THE MUD!

SPIRIT HUBAND MATTER!

GEN Z!