MATERNITY WARD DRAMA!

Una wehdone o! My fellow country people!

How dey go, dey go?! I hail!

Na noise we hear inside hospital as I follow person go greet person!

The woman wan come deliver, she begin wail, lament, pray...nothing wey she nor do!

Na only her elderly Mama follow her come there.

The Mama dey try hold her make she nor wunjor herself! As she dey fling hairnet, na so she dey fling slippers!

Nurses say make them leave her, as the shout go help pursue the baby comot! 

Una say wetin?! *jawsopen!*

The Nurses just dey waka pass like say na nothing!

As we enter go greet our person wey just born, Na she tell us say the woman's husband abandon her for midnight since 8months ago! 

The baby don almost due now, as she come hospital na so so strong, strong words they comot for her mouth! *Hmmm!*


The one wey my spynoculars carry, na when she call the husband full name say 'na only if no be him be the first and only man wey climb her, make everything begin work against am until he come back house!'*Choi!*

Her mama dey close her mouth say make she nor too talk! 

Nurse wey dey duty for reception, dey chop bread and butter, carry hot tea inside one gigantic mug, waka pass inside like say nothing consain her!

I say Aunty nurse, una dey try o! 

She say na me dey worry! She say the kain lives wey don scatter ontop woman 'under', na only God fit repair am! *Ha!*

Aunty Nurse point the woman wey dey wail say, the woman na technical virgin she be, as na just once the husband touch am wey she carry belle and he disappear with another woman! 

She say make i dey watch o! Say if the man dey innocent nothing bad go do am!

But if not, she say anything wey the woman talk inside that pain! Heaven sef nor go reject am! *Chisors!*

Hmm...Na so I begin hear shout of another woman. Her husband go buy her Amala come, she shout for him head say na Semo she send am o! Say Felix why are you frustrating me like this?!😂🤣😂

Full grown man wey gather bearbear with Abolo head o! He don climb stairs like 1million times! 

Na as he dey buy boiled corn, na so he dey find avocado upandan.

 Later, I see am from window as he leave car, carry plate dey cross road, begin find wetin nor loss!...Abeg if this man nor gree touch him wife again, who go blame am! 

He see shege! 

When time reach to enter theatre, they carry cap and scrub give the Abolo man! He say he nor wan enter o! God abeg e! 🤣😂

Aneva see man wey fear him wife like that! He ask Nurse if him wife go sleep during delivery?!

Doctor say Mba! No be operation, so na she go push by herself with her eyes wide open! 

I wan sidon for grand, raise leg, mah laff the Abolo man!

The wife say 'baby come closer so I can hold your hands'...I don laff, scatter leg for ground! Nna ehn! 😂🤣

Anyways na twins she eventually born! No wonder na double stress she give her husband!

Back to the woman wey  dey very sad! She come talk another one say if God truly be God, say if na juju carry her husband comot house, make the thing spoih, meh he waka come back with clear eyes, before the pikin come!

The Mama shout say No o! 

She say If the man no gree come another year nko! Say make she nor dey talk like that! Choi, i be wan dey emotional!

She just dey call him full name plus him mama name say anything wey that strange woman use tie am must scatter!Because she nor thief person joy!

That one show say power truly dey inside a praying wife's mouth!

They carry her enter go check, they ask if her mother wan enter with her? As na her only relative she sef insist say, Yes!

They enter o...they tehhhh...I dey hear her say my husband is coming! God has gone ahead of me! My baby your father is on his way! 

Nna ehn, anor gree go house! I begin stretch neck, begin ask Nurse say how far?! 

Nurse say pikin nor gree commot and she just dey shout her husband name say wherever e dey! E must come! Say she dey take back her marriage by force by fire!

Woman wey dey get pain, wey dey speak in tongues say she nor go fold her hands again! Say no be wetin God promise her for marriage be this!

Aunty Nurse for reception, don go carry chilled Fanta and chin chin to top up! 

She sidon begin watch African Magic. I just dey wonder how dey get mind like that!

Nor dey underestimate Nurses o! Their eye don clear! If you do anyhow, dem get your size!

Another couple come, the Ajebutter husband say he wan drop him wife with doctor say she dey Disturb him for house! Make dem give her private room with television. I laugh no be small!! *women e!*

The wife go run follow him dey cry like small pikin! The Ajebutter husband say, e wan go buy pizza and chicken and bring for her! Na that time She leave him hand o! God abeg!🤣😂

We still dey laugh their drama when one Tall, fine man enter the Reception. 

He ask for him wife name. Aunty Nurse wey dey chop chin chin, look the man ask him sir, where you dey come from for this late hour? And wetin dey the box wey he carry?! 

He say na Abuja he from come. Say him wife send am text since yesterday say she dey this hospital to born, but he just dey see the text that evening, Na why he come!

E never reach 1minute wey that man enter that reception wey that woman born o! 

One Nurse comot from inside there, the Chinchin Nurse follow am whisper something!

They carry the Abuja man near labour room door to peep him wife and pikin!

The Mama commot to hug the Abuja man, begin talk their dialect dey thank God as she dey use wrapper clean eye! 

The man enter go see the baby and wife!

Hmm!..the kain orisirisi things wey the Nurses and Women in Labour eye dey see ehn! Words nor fit quantify am!

I dust my slippers dey go house! 

Abin wan ask the Abuja man if na Adultery or longer throat dem use hook am for Abuja?! 

I for wait, but i never warm my soup for house! I fit find dem go house sef! *sideeyes!*


Comments

Popular posts from this blog

SUGAR BABY IN THE MUD!

VOICEMAIL SUITOR!

GEN Z!