LANDLORD AND THE WIG!
Una doh o! I hail o!
How every every?! God no go shame us!
Na im we wake up this morning! As bucket dey fly, na im shoe dey descend! 😂🤣
Wetin hapun?! Wetin hapun?!
The two Aunties wey dey live downstairs, be like dem join money buy wig. So dem dey alternate am!
Atink, na one money plenty pass the other, but both na shareholder!
Anor know wetin really cause the problem but we dey hear the main wig owner dey say wig don lorss! How she wan go work as she nor get front hair! And dey nor dey allow colored wig for her working place!
God abeg o!
Wetin do your front hair?! Na bonnet she dey wear for compound so we nor dey ever see the true nature of her head!
This one nor be wetin oyinbo dey call alopashia, go google the thing! *anor kukuma go school!*
As bonnet don fly comot during fight! They nor wear waist girdle! No eye latchis or make up!
We never even try settle kworeh wey Landlord don call police come!
Baba why you call police?!
He say why outsiders go come him compound dey fight!
Outsiders kwa! Oga landlord na Aunty May and her cotenant Aunty Rose o!
Landlord wey nor dey quick see road for normal day say nor be people wey he carry give room be this! E nor sabi dem! 🤣😂
True true ehn, if person look these Aunties one wan resemble that old man Abija wey get bald head inside yoruba film, wey dey do no-nonsense Babalawo!
The second Aunty wan be like speed darlington from upper angle! From your angle, you fit see ogunjimi wey dey that JagunJagun film! Anor know as your angle teh be! Exactly! Beauty dey inside the eyes of the beholder!
Anyway, so as erm belle fat dey go left, na im the bald head dey go right!
Wey dem suppose find better gym go register! And reduce consuming beer like man!
Even though we know say na like Rihanna and Beyonce dem dey resemble for broad daylight!
We nor see wig matter settle wey police don carry dem go as intruders.*Anevasi!*
Why you go dey tell police say do you know who i am?! Aftoroh, even your landlord nor know who you is, so how police wan teh know?!
Some Nigerians nor dey hia word! Nor dey brag if you still dey hustle! Nor go dey discourage helper say you don blow!
As dem come back house, na Aunty May younger sister bring wig come say she borrow am go club!
Mah nor talk who that one resemble, she geh luck say landlord nor quick see am from balcony!
Nna ehn, elders wey say if you wan marry, na to go visit your in-law before day break!
Nor be lie dem lie! E get why!
Comments
Post a Comment