COST OF BEAUTY.
Kpoi! Kpoi! Na who dey haasee e?!
I greet una!
The other day wah enter one salon for area,
I say i wan buy brown eye pencil.
Na im the Aunty say na N500! *Hian!*
I say for pack abi bundle?!
She use bad eye look me!
Nor vex!
She carry only one pencil come!
I say which time ordinary eye pencil come corss like this?!
I never even drop am, waka reach door wey one Madam enter, say she don late for the party wey she dey go!
As i see am, I don already sense say this one na content!
Na so i pull chair sidon say i dey wait person!
They do the Madam...sorry Aunty face finish,
Anor even recognise her again!
If una see eye latchis wey dem gum her! De thing long pass handfan!
Small breeze from Industrial Fan. This latchis go fly carry the Aunty comot the party na!
Tailors these days nor jor gather conscience, be like dey don join work with carpenter dem!
Because, the kain corset wey dem dey do for dress these days ehn, the thing dey more effective as spinal cord POP!
I be wan ask say, Aunty abeg, shey you get exterior lungs abi na thesame one wey dey inside body?!
This kain corset na wetin dem suppose call Fashion Botox! Person nor go fit laugh genuine laff wey dey come from bottom of the heart!
To chop for party sef na war, na take away you go see person pack go house!
God forbid say eeparipa happen! How person go fit quick turn and pick race!
To enter Danfo with this kain dress na criminal offence! If you see person wey wear am, try to enter Keke, be like when person wan carry standing fan put for Keke back seat!
This one off me abeg! Odi Snatch it! Snatch it!
Make person nor go chit im intestine comot one day!
Na Make up Artists dey reign now o!
Gone are the days wey parents dey shame to say na Salon dem put their pikin to learn work now!
Infact i hear say to learn work for salon and do freedom now, nor be small money o! The number of men inside salon sef don pass women!
The kain money wey dem dey charge go make you run go youtube, go learn!
Ordinary attachment too wey be N500 for one, before don reach N2,700 naira now! Even the quantity sef don reduce!
Wool wey our sistas dey use go church too don corss!
All because celebrities dem don dey do ponytail and box braids, the merchants don increase the price.
Now normal person like us, nor fit jor go market come house and do Bob marley in peace.
At this point, na to go cut Abolo o!
Make person dey rub oyel everymorning.
Buy facecap and plenty headtie as support!
My neighbour wey say she dey do team natural because she wan celebrate her heritage!
Pele o! Archeological museum for hair follicles!
Like say anor know say na to cut cost!*Sideeyes!*
See as people dey jor cut low cut, rub am golden dye these days! *clearsthroat!*
We know say some pipu nor go ever talk true say na the economy cause am! Wig nor be anybody mate again! E nor dey smile!
Some go say na because dey wan make breeze dey blow dem scalp! Another go say dem dey do kolese, wey oyinbo don turn to cornrow say na protective style!
Na since dem gee kolese Wikipedia name na, e don begin corss!
As human hair now fit buy land and do foundation for Ikorodu! E fit buy tokunbo Car sef!
Be like people don dey realise now say, if thief snatch wig of N500 taasand inside this economy! Investment don go be that!
Meanwhile if person use that money find better property company or even invest for stock business. E nor fit regret am!
Nor be the one wey dem dey draw map for television with worgoworgo line o!
Stock as in Real Stock fish!
See you o! You nor know say money dey inside the business?!
You know how much tiny okporoko be for market these days?! Hian!
To cook full pot of vegetable soup with okporoko, person nor fit spend less than N1 taasand.
Abeg go do market survey come fest!
Na only food business get gain these days!
Even if na cooler you put for roadside, person go still find you come!
Comments
Post a Comment