U na kpoi kpoi kpoi e! Hmm... For the compound wey face our yard! One innocent looking, female corper dey live with one of her female friends! Small time, one married young man begin find her come. He nor too teh wey he buy her car! Everything dey go well, until one day wah dey waka pass! *sideeyes* No be say I waka pass like that, like that...I don already pass, so I come re-waka again. As I sight the man inside him car ontop phone, when he dey vibrate like vulcanizer engine! He begin shout! Make she nor call my number again! If I like, I will not send money or even bother to see my children for another ten years! It's my business not anybody's! He cut phone! Hmmm.. Confuse come catch me, so I begin watch the man with my internal eyes! So this man deliberately abandon wife and shidren, he come port sinceee, and turn himself to Bachelor without divorce! *Na wa!* Anor even know as emotions just carry me that day, wey I remember some of my schoolmates when we dey Primary...
Kpoi! Kpoi! Kpoi! Na who tie rope for gate? Una Goat don waka reach Junction o! E nor even remember wear shoe! My good friend say her family na soap opera! She say her Grandmama cause plenty problem nor be small! She say the woman don carry spirit husband dash all of them ahead ahead before dey even born most of them! She say the woman sabi jump from one gini gwanu to the other! Say if persin ask her, she go say na to protect her children! She say out of 12 children wey Grandma born, na only 3 manage and stay! Two boys and a girl wey be her own Mama! She say as their Grandma kpai like this, she don handover the 'thing' give her own younger sister wey dey with her for village during that time! She say she sef begin suspect that her younger sister and her mother because e get how dem dey sleep for night! God abeg e!😂🤣 She herself turn to monitoring spirit! I say why you nor follow dem sleep like that? She say blood shortage go worry her for leg! *yeye geh!* ...
K poi! Kpoi! Kpoi! Una well done o! How market and hustle?! E go better! I sidon for my side, na im oga Peter waka pass with him container! I say make i check for new dross and patronise him. Oga Peter first daughter waka pass, inside school uniform with her friends. She no wan greet her Papa o! Na me say Georgina, how school today?! Be like say hunger don comot your left eye, wey you nor quick see your Npa ba?! She squeeze face, greet herself with shame and pass! Oga Peter say him pikin tell am say, make he nor dey advertise women wares come her school area! She say her friends dey laff her, say her Papa dey sell dross! *Udonminit!* I say thesame money wey you dey use send her go the school?! Buy books, uniform and sandals! I say she 'couldn't' be! The next day, after I don open shop put person there, I call Oga Peter for phone say I get customer for am! He join me for junction, I carry am enter him pikin school! He nor wan follow me, begin look if him pikin go see am! N...
Comments
Post a Comment