SOME MEN EHN! 😂🤣
I greet o! Na who dey haasee e?! Doh! I dey my customer area, I say mah stop and greet her. Her Ada don wed, but she nor too dey visit like that! Even though na still this same Nigeria she sef dey! I say so how she dey take hol boredom? She say na her husband be her Taataa now! Taataa as how?! He still dey find bwess wey nor dey obey gravity?! *side-eyes* She say that one for good, but wetin dey do am now, don pass wetin gravity wan uphold! The husband begin exhibit midlife crisis at over 60! He begin dey go mall to buy Skinny Jeans on top Polo and Face cap! I say on top that im alligator pointed shoe?! She say MBA, be like he been befriend one Aunty for that mall, wey her name be Nike. As na every thing he carry come house na her name dem put even as sales gini gwanu! *Side-eyes* i say abi make we gather and recommend one bros gee you?! *sideeyes!* She say Tufia! She nor reason any man since 18years, wey she marry her Golden Husband! I say...